Friday, November 28, 2014

CHAI...NAIJA DON DUPE US O, PIPU WEY WIN 100 YEARS BYDAY LOTTERY DEY CRY

No be small thing many pipu wey try dem hand for the Naija 100 year
byday lotto don dey para, dey cry o, say dem don win many many
different things but sha o, he be like say na job dem job dem o cos
dem never fit collect wetin dem win. Na the Centenary Committee
polongo say dem don arrange the Lotto together with Secure electronic
technology Limited.
The big promo say dem go dey give pipu car, one per day for 90 days
plus including other better prizes but sha o, one Tony Okeke dey claim
say he don win 60 million naira as per say he win for one of the
categories and since den na so so push dem dey puah am around o, he no
see the money collect. Even pipu wey win laptop sef dey para say dem
naver see am collect. Dem dey vex so tey dem dey go swear for the
committee on top dem facebook page.

No comments: