Friday, November 28, 2014

POLICE DON CATCH THE YEYE WOMAN WEY THIEF 4 PIKIN FOR KANO STATE


Dem don show the face of One 29-year-old woman, Love Ogar, for
Nomans-Land Chief Magistrates’ Court on top say she kidnap 4 pikin for
Hotoro quarters wey dey Kano metropolis. The police prosecutor,
Inspector Shaibu Musa, yarn the court say na on November 12, 2014, she
do the bad thing.
Dem come carry am go court say she do criminal conspiracy plus say she
kidnap. Inspector Shaibu Musa yarn say wetin she do dey against wetin
dem write for sections 97 and 273 of the penal code of Northern
Nigeria. But sha o, she say na lie dem lie for her head o, say no be
so.

No comments: