Monday, November 17, 2014

3 GBOSA FOR WE MILITARY AS DEM DON COLLECT CHIBOK BACK FROM BOKO BOYS.




NAija soldiers don take chibok back from Boko haram who seize am on Friday, na so the Oga director for Army Public relation, Brig-Gen Olajide Laleye yarn for inside one text message wey him send on Sunday.


The Oga say na on Saturday night dem take am back, and dem don dey arrange everything well make e for make senses, and some pof dem still dey shase the bad guys wey dey run. But sha o before dem talk that one finish na him tori dey spread again say one female bomber don go throway bomb again for ICT market wey dey for Azare in Bauchi State on Sunday. By the time wey dem dey write dis report, Police PRO for bauchi say dem never know the number of pipu wey die but dem sha don rush pipu wey woundjure go hospital.

No comments: