
Saturday, March 8, 2014
YOU BE CRIMINAL O, IF YOU NO CHANGE YOUR PLATE NUMBER BEFORE JUNE 30-FRSC
FRSC Oga don loud am yesterday for Uyo, Akwa-Ibom, wen he dey talk through one of him guys, the FRSC Commander for Zone F, Mr. Nsebong Akpabio, say if you no change your plate number to the new one wey dem don commot, you go turn Criminal under the Federal Road Safety Act 2007 and HighWay Act of 1972.
He say no be only plate number mata o, everybody wey no gree give dem the details of hin car, him chassis number. The man say he happy say people for Edo and Delta wey be Zone F dey do well as dem dey couple dey obey the Law.
He say dem get 31places where dem for dey give pipu the number plate so make dem go take am there and no be all those magomago under G things. He say make pipu stop to dey go other states dey collect
number late dey sell say anybody wey dem catch go smell Legal pepper.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment