If you
dey follow the mata as e dey go, you go remember say for time wey not too tey
na him Oga Governor for Kano State, Rabiu Kwankwaso carry megaphone loud am say
Uncle Jona, our presido carry 2billion Naira take bribe each of the 16 Governors
wey bin vote for Governor Jonah Jang of Plateau that year to make him be
Chairman for dem Governors meeting,
whereas dem wey no vote for am, wey line up
for Amaechi back say Bros J, no gree roger dem. And na the same presidency use
that magomago somtin take scatter the Governors meeting. He say if no be so why
Federal Government go talk say dem sabi Jang as dem chairman wen e be say na
only 16votes him get wen Amaechi get 19.
But yesterday sha o, the person wey the mess dey smell for him body, Gov. Jang don vex talk him own through a note wey him commot from dem own NGF office and sigbed by one Kassim Yakubu, he say na lie go kill Kwankwaso o, say na that him lie lie mouth he take break the Governors meeting say Federal Government no know any thing for the matter. He say if dem roger anybody at all, na Kwankwaso e go be cos say na him(Kwankwaso) nominate am wen dem Governors for North meet to know who dem go commot as dem candidate. He say na him and some of him bad belle Governors for the meeting cause the katakata but now e be like say den don dey regret why dem do am, and dat na why dem just dey run
their mouth dey lie so so lie wey no fit hold water.
Jang say na fear dem dey fear, dem Governors for the other political party cos dem dey loose dem members, na him make dem dey think am say dem fit bobo Nigerians with all dem Super Story. He say make Kwankwaso come talk am if him Roger am that year make he take nominate am.
The Bros Jang come tell us say make we Naija pipu dey shine our eyes o before we go believe anything wey dem dey tell us o, say na so so lie lie full dem mouth.

No comments:
Post a Comment