
Saturday, March 8, 2014
NO BAIL FOR YOU AND YOU NO DEY GO ANYWHERE, COURT TELL BOKO HARAM KOGI LECTURER
One Federal High Court for Abuja on Friday don take him time tell one Arabic Oga and Lecturer for Kogi State University, Dr. Muhammed Nazeef Yunus, Salami Adbullahi a.k.a. Asta and Musa Umardey answer question on top say dem dey run package with dem boko boys.
Justice Gabriel Kolawole wey dey sit on top the mata clear dem yesterday wen the mata show for court say make dem commot am for mind say dem wan get bail, say dem no dey go anywhere because the offence wey dem catch dem for na very big one, and the serious gbege wey our country det face from dem padis, dem boko boys, especially as dem go fall innocent school children for Borno State recently. So he tell dem say dem no dey go anywhere, him refuse dem bail but he say dem go try speed up the mata, make dem quick know wetin go happen to dem.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment