Friday, March 7, 2014

WHICH KAIN BAD BELLE BE THIS, APC DEY VEX SAY DEM SIDE LINE RIVERS FROM WORKS BUDGET.


APC for Rivers state def vex for Federal Government o, say na which kain bad belle be that, how Federal Government go sideline dem from budget of work project wey dem wan do this year. Say na this one dem take confirm am say the federal Government dey really beef dem State.
 

Na yesterday one of the guys of the interim Chairman of APC for Rivers State Chief Chukwuemeka Eze, talk the mata on behalf of the Chairman, say na like electric shock wen dem realize say dem no give dem any thing for this year budget, say all this one wey dem Minister of Works, Mr. Mike Onolememen dey talk for House of  Assembly Committee say no be beef, Bros J no dey beef Amaechi na Super Story Season 3. The party come hail their better pikin Chairman House of Reps Committee on Petroleum (Downstream), Hon. Dakuku Peterside as he waka commot from the bad belle meeting where dem for declare say nothing for River state dis year.

Dem come dey try call attention of Federal Government to some projects wey dem suppose do for Delta, say make Nigerians help dem beg Bros J o make he no take vexnation with Amaechi take finish dem state o, as dem don collect like 2 Oil wells from dem wey make dem state money drop from 19billion to 13billion, say dem wan even collect loan take better dem life but Bros J no gree sign.

No comments: