The
second Oga for our senate, Sen. Ike Ekweremadu don para yesterday o say dem
neva born any body mama well make dem try reason am say dem wan block the way
of former Governor for Enugu State, Chimaroke Nnamani, wey wan run back to PDP
like the prodigal son wey dey bible, he say after all our 1999 constitution
allow person to join any group wey sweet him belle.
Make una no go forget say na last week Bro Nnamani announce say him don run go back PDP, after he don try hustle senate seat wey dey for him area, with one kain political party wey him form PDC (People for Democratic Change) in 2011 but the level no pure for am that year. But dem PDP Oga wey dey Agbani ward for Nkanu West Local Government dey clear am say him return na for him dream o, say na nonesense him dey do as per say he no do the right thing, he no follow due process, as per say wetin dem party constitution talk say he suppose first write letter to the party secretary which he no do, therefore him porting to PDP na film trick.
But the 2nd Oga for our Senate wey dey represent Enugu West for senate, Sen. Ekweremadu dey clear dem yesterday say make dem no try reason am at all, dem never born any of dem well make dem try hold Nnamani make he no rejoin the party. He say dem gats consider all the things and the kain actor role wey Nnamani don play wen he bin dey the party. So make dem no just reason am and if dem reason am, make dem no talk am come out.
No comments:
Post a Comment