The
person wey be Oga for now, for the Social Democratic Party (SDP) wey bin don die
tey tey, Chief Olu Falae talk am on Friday o say make Naija pipu dey rejoice o,
as the party don wake up to make corruption suffer and make life better for
Naija pipu in 2015.
He say the party dey come back to give himself to Naija pipu to tell them say e go better, give dem better name and cause serious gbege for corruption. He talk all this wen he dey yarn with dem News Pipu for Abuja say na to make life better for every single person from the time wey dem born dem to the time wey dem go die be the koko of dem party and na him make pipu gree for the party wen he first show face for Naija in 1989, wey make am the most poular party dat year.
He say the party don notice many things wey no make sense for our country, things like poverty, hunger, chopping of community manner, spending money anyhow and so on, and den come realize again say na
corruption be the mama of all dis yanmayanma things so dem dey ready to fight and kill corruption for Naija.
No comments:
Post a Comment