Monday, June 20, 2016

NASO... NAIJA ARMY KPAIN 3 KIDNAPPERS PLUS SAVE 3 GIRLS FOR BAUCHI

Men of the 33 Brigade Command of the Nigerian Army, Bauchi State, don kpain 3 kidnappers plus rescue three girls for den custody for inside Ningi Local Government Area of Bauchi State. The Commandant Operation Flush Ningi, Major Boyi Uba, wey yan news men for Bauchi,  yan say na for exchange of fire nahin den kpain the kidnappers. Hin yan say guys wey dey hin squad try wella.

No comments: