Monday, June 20, 2016

REMOTE DON READY TO TAKE CONTROL AS HE DON READY TO DO HIM FIRST SHOW

One of the youngest comedians wey dey make brain pass for Naija, wey still carry Second for last year ALI BABA spontaneity show, Remote wey him real name na Tolulope Olayiwola don ready to put him career for anoda level, sake of say he wan do show. The show wey he call Remote in Control, na him him dey arrange with ‎House of Catalyst. If you Sabi Remote, you go Sabi the kain excitement wey Ibadan pipu go soon enjoy, anywhere he go he dey take laff finish pipu Belle anyhow, na so he do for Rapindady show, Spartacus on the 5th of dis month. Anoda thing wey go make the show make brain, na other comedians wey he dey invite, pipu like, Dr Frick, Arole, Abiri, BBO, coded etc. Na one badt afro Musician, M. Gabriel. go play music and na MC Ambassador go host am together with Afouda. To come ginger us finish he say one big person go do Special appearance but he never yarn us who the person go be, he say make we dey guess. The event go shele for The Eminence Centre, 1st Floor, wey be BJ rentals before beside Sango Cemetery, mokola-UI road, Leventis for Ibadan on Sunday  17th July, 2016 and 3pm . He say for gate fee, just see say you wear cloth and you no come alone. Lobatan. But if you still wan support the badt guy career, abi you wan Sabi more about the show, halla any of this 2 number,
08030501536, 08137634982.

No comments: