Friday, July 8, 2016

ABEG NA WETIN MAKE FLAVOR N'ABANIA GO DEY ACT FILM ABI TO DEY SING DON TIRE HAM???

Miss Simplicity - Base on sey e no gud make person dey hide talent wey Baba God give ham, naim make Flavor N'abania wey be correct singer wan pipu show sey him get acting talent o..
Flavour don turn actor o nd him dey for where him nd many ogbonge actors nd actresses like Kanayo O Kanayo, Queen Nwokoye nd Mercy Johnson for dey cook one film wey d name be Professor Johnbull oo..
Flavor play piano for d film nd wen dem ask Mercy Johnson sey sey hw she see flavor o, she tok sey Flavor play wella o.
Na d first time wey Flavor dey act bt Mercy Johnson still tok sey she enjoy him acting nd singing o...
Na so, oga Flavor congratulobia o, we dey long our throat dey wait d film oooo...
See sum pinshures wey dem take for the place afta d cut...

No comments: