Presido of we Senate, Abubakar Bukola Saraki, yesterday gree say thief move N12 milla from hin house for Ilorin, wey dey Kwara State. Saraki for one statement wey hin Special Adviser on Media, Yusuph Olaniyonu, sign for Abuja yesterday say the mata shele 2 weeks ago for the administrative quarters wey no far from the house. Saraki say. A big lie O, money wey dem thief no be N300 million and say he don report the mata give police and dem dey shine light on top am. He still say the money no be una own O, na him personal money. The bros no stop am for there cos he take style yab SaharaReporters wey be say na dem help am loud the mata, cos even the title of the statement na falling hand for dem, he say na so so lie dem dey always lie, dey make mata bug pass as e be for real life.

No comments:
Post a Comment