Opara say immunity wey dem wan give National Assembly members no necessary for now. He say why dem go dey reason dat kain thing, no be him we suppose dey reason now. He even say immunity wey dey for Presido, wey dey inside we constitution, dem suppose commot am so pipu go fit answer for dem offence when dem dey office. When Aviation Minister before, Chief Ebenezer Babatope, go yarn him too say immunity no make sense now O abi wetin dem even dey find immunity for? Afenifere wey be Pan-Yoruba socio-political organisation too say if dem give dem immunity dem Igara. Dem National Publicity Secretary, Mr Yinka Odumakin, say na sign say dem no serious be dat one wey dem dey find. He say dem still dey find how dem go commot an from Governor, na him dem come dey say dem dey find immunity. SERAP too say the proposal na selfish something wey no make brain at all.
No comments:
Post a Comment