Monday, June 20, 2016

IF YOU NO LEAVE WE OGA ALONE, KASALA FIT BURST FOR NAIJA O: SENATE PARA FOR EXECUTIVE

Senate on Sunday don para say the forgery case wey dem carry go court by the office of the Attorney General of the Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami, against dem Ogas for inside Senate na coup against the legislature. He say wetin dem dey find be say dem want make executive dey control National Assembly. Dem still say na some party leaders dey ginger the trouble, sake of say dem sha wan commot Senate Presido Bukola Saraki and him deputy, Ike Ekweremadu, and see say dem keep dem for prison and dem no fit do dem Oga work for inside the Senate again.  The Senate, for one statement by the Chairmo, Senate Committee on Media and Public Affairs, Senator Sabi Abdullahi, say the forgery mata no follow constitution and e no suppose be cos he no follow principles of separation of powers plus checks and balances. Dem say if dem no stop am, the thing fit burst kasala for our we country O, so make President Muhammadu Buhari warn Malami O. Dem don carry mata go court say dem forge and dem do conspiracy against Saraki, Ekweremadu, plus the Clerk of the National Assembly, wey just commot, Alhaji Salisu Maikasuwa, plus the Clerk of the Senate, Mr. Ben Efeturi, for one Abuja Federal High Court.

No comments: