The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don seize over N126billion from accounts of some suspects sake of say den no wan make e affect investigations. The agency yan say
More than 120 bank accounts dey affected by the freeze order. About N126,563,481,095.43 nahin EFCC don seize till den finish case ontop den. Other cash plus assets under Interim Forfeiture be $9,090,243,920.15, wey den don seize from suspects wey dey facing trial or dey under investigation. Apart from freeze wey den freeze N32.8 billion from six suspects wey dey Police Pension Office, some high profile suspects wey den account dey among the ones wey dem seize. be ex-Minister of Petroleum Resources Mrs. Diezani Alison-Madueke, ex-National Security Adviser (NSA) Col. Sambo Dasuki (retd), ex-Chief of Defence Staff Air Chief Marshal Alex Badeh; ex- Chiefs of Air Staff Air Marshals Adesola Amosu and Mohammed Dikko Umar; Robert Azibaola( ex-President Jonathan's cousin) and ex-Minister of Aviation Femi Fani-Kayode, plays others.
Tuesday, June 14, 2016
OH BOY EH! EFCC DON COLLET N126B FOR 120 ACCOUNTS
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment