Parents of 20-year-old student for University of Port Harcourt, wey die inside Choba River on June 1, 2016, no gree for pre-burial sacrifice wey Choba community say dem wan do. The community dey say the parents go pay N115, 000 take do sacrifice before dem go fit bury the late student, Omoseebi John Temidayo, but the pikin Papa say lailai, him na Christian and hin no dey support dat kain sacrifice. Temidayo, a first-year student for the Faculty of Art and Humanity and na inside Choba River he for drink water die, when he go hustle for one construction site. Na after some days some pipu wey don dey find am see am, and dem later bury am as e be dem custom for the community. The Papa of the boy wey kpain, Mr. Andrew Omoseebi, gree say the body of him pikin wey don dey spoil say make dem carry am go dem village for Oke Oro Ijero LGA of Ekiti State, but he no gree with dem king for Choba, His Royal Highness, Eze Raymond Okocha, say dem go pay N115,000 for sacrifice. The king say he no follow dem drag on top the sacrifice as per say dem wan bury the pikin for riverside, say na tradition dem just dey try follow. The boy Papa say him no talk say he no wan follow dem tradition but how dem go dey say make he come pay 115k when no be say na wife dem wan marry.
No comments:
Post a Comment