Friday, June 17, 2016

GBAM!... STANDARD ORGANIZATION FOR NAIJA ENTER IMO MARKETS, CLOSE DOWN 12 SHOPS

Officials of the Standard Organization of Nigeria, SON, yesterday enta some markets for Owerri plus oyher tamak, ontop say den wan clear fake goods comot the market. The operation enta many many hours as den see say na fake fake products full the market. The South East Regional Oga for Standards Organisation of Nigeria, Mr. Charles Emeka Nwagbara, yan say na we presido plus federal government yan say make den make sure say den comot fake fake products comot market for Naija. So if na fake you too dey sell, dey look your back o , cos dem go soon reach una area.

No comments: