Friday, June 10, 2016

(FOTO) ONTOP CARPENTER WEY MUSLIMS YOUTH FLOG.. NA TRUE WETIN EL-RUFAI TALK ABOUT RELIGION?

Gov. Nasir Ahmad El-Rufai of Kaduna State don vex yab the bad pipu wey wan take religion plus tribalism burst kasala for the state, say dem no dey force person do religion. On Tuesday night, one church leader for Kaduna confirmed say some young pipu go hayaj one carpenter named Emmanuel Francis sake of say he dey chop when Ramadan fast dey go on, even as the guy explain give dem say him no be Muslim.  Pipu wey hayaj Mr. Francis do am strong thing leave am inside him blood as dem don cut am plenty, before pipu rush am go Saint Gerald Hospital Kaduna wey be mission hospital, for treatment. Governor El-Rufai, and him deputy, Bala Bantex, show for the hospital around 12:20 p.m. t.co see the guy where dem for plaster am join bed. Na for there he para say government no go gree make anybody use him faith do excuse take commit crime. He say dem no dey force person do religion na.

No comments: