Saturday, June 4, 2016

(FOTO) HON DAPO LAM ADESINA DON TAKE HIM PAPA NAME START BURSARY FOR STUDENTS




Hon. Adedapo Lam-Adesina, wey be lawmaker wey dey represent Ibadan North East/South East Federal Constituency for the House of Representatives Abuja, don start one bursary package wey he take honour him Papa, Alhaji Lam Adesina. The package wey dem call Lam Adesina Bursary for tertiary institution students na him dem start on Friday 3rd June,2016 wey dem wan do for collabo with Federation of Ibadan Students Union(FIBSU). To start the beta thing wey no go make Lam Adeshina name die lailai, him pikin wey be lawmaker see say he sama some 150 students wey dem pick from different tertiary institutions across Naija, the package and if person put one and two together you go sabi say na millions of Naira dem take arrange the package. One of the students wey chop the Awoof, Taiwo Abass wey yarn for the event sama beta hailings give the young lawmaker come pray for him success. Some of the pipu wey dey there na pipu wey represent Oyo Apc Chairmo, Chief Akin Oke, Deputy Governor before of Oyo State, Barrister Iyiola Okadokun, Chief Ayo Eniade, Mogaji Makinde, Chairmo of Apc for South East and North East, FIBSU Presido plus other Exco member (see more pinshures after the cut) 


s, Leaders of different Communities etc

No comments: