Nawa O.... Yesterday tori wey dey waka be say dem don free Oyo Labour leaders wey police catch sake of say dem go do Aluta for one kain stakeholders forum wey Oyo State Government arrange to follow pipu wey get mouth yarn on top wetin the government dey plan for education for the state, maybe to sell abi dem no dey sell. Yesterday police carry dem go court and na everybody dey happy when dem hear say dem don free dem on top bail Parole, but fear catch many pipu dis morning when Comrade Babalola Borishade call enter Voices, one popular radio programme on top Splash Fm with Edmund Obilo. Oga comrade say na true say DE sama dem bail, but afta dem do everything wey the bail ask for, court say dem wan verify everything, na so time take go wey dem no fit finish am, na so dem say work don close for Friday, so office don close till Monday, wey come mean say na Agodi dem go crash for the weekend. Comrade Aborishade say na Agodi dem Labour Ogas dey do dem weekend O. Many pipu don dey vex dey para for the state government on top the mata.

No comments:
Post a Comment