Lagos State Police Command don catch one man, Ike Iwuanyanwu, say he take by force chop the dodo of him 15-year-old daughter, Priscilla come even give am belle for Ajao Estate wey dey Isolo area of the state. Tori yarn us say Iwuanyanwu, wey be company driver and dey stay for Anuoluwapo Street for the estate, na hin dem catch on Wednesday dem report the matter for Ajao Estate Police Division. We hear say Lagos State Government don carry the girl go custody. Tori yarn us say Iwuanyanwu dey even flog him daughter and wife, day Make dem no yarn anybody wetin happen O. We hear say the girl mama yarn her family pipu on Wednesday, wey come go the girl school go conform the tori. Na those ones come go report the mata for the Ministry of Youth and Social Development, wey yarn police. One of dem neighbours, wey say make dem no mention hin name say the girls na the first pikin for dem family, and say the Papa don confess winsh, say na true him do the bad thing.
No comments:
Post a Comment