Monday, June 20, 2016

FG BAILOUT : GOVERNORS WAN USE RESTRUCTURE TAKE BOOST DEM STATE MONEY

The Governors for Benue State Samuel Ortom plus Oyo State, Abiola Ajimobi, don dey yan say den no happy as some states no get liver to take pay workers. Den yan say den gas find beta way to take end all the economic wahala sake of say dem fit standa gidigba even if FG no get liver to pay states bailout. Den yan say all the states den gas begin reason way wey den go fit dey find money to take pay workers sake of say na state the workers dey work for no be FG so if federal government no get liver pay state, state still gas find money take pay hin workers.

No comments: