Friday, June 17, 2016

CERTIFICATE GBEGE : COURT DON PUSH BUHARI MATA GO DATE WEY DEM NEVA SABI

The Abuja Division of the Federal High Court, yesterday, yarn say make den move go date wey dem Neva sabi one case wey dem carry against we presido ontop say he no go school complete. Na one lawyer, Mr. Nnamdi Nwokocha-Ahaaiwe, carry the mata go high court. For the sitting, nahin Justice Ademola Adeniyi push the mata go date wey dem Neva sabi sake of say den wan make Court of Appeal finish the case ontop one appeal wey President Buhari carry come  against the mata.

No comments: