Friday, June 24, 2016

BUKKY AJAYI NA MY BAE ND NA MY PERSONAL PERSON....RMD


Miss Simplicity - Richard Mofe-Damijo wey we dey call RMD naim don sama him fans wit old pinshure wey him bin take wit Bukky Ajayi wey be veteran actress nd wey don dey use wheelchair bcos of old age o... For d foto, RMD dey sama Mrs Ajayi peck for her cheek o nd on top d foto he write sey Mrs Ajayi na d sweetest person wey him ever knw for d face of dis earth o base on sey she dey always smile, she still dey young for heart, she dey ageless, gracious nd graceful.  RMD call Mrs Ajayi him Bae, personal person nd him very own... Wow dis tori dey totori my body, see love, see respect...if dis tori reach d actress ear, e go ginger d actress her well well nd e go help to make her hapi sey her fellow actor nd actress still dey appreciate her nd all her work wey she don do before... Oga RMD keep d flag flying, ur head dey there o jare...See d pinshure afta d cut



No comments: