Nawa O, make Baba God sha dey protect us ni O. Tori wey dey waka dis evening just dey yarn us say na God save players of Ikorodu United plus dem officials for one kain yeye accident where many pipu for kpain around Dat kain 4pm for Ama Brewery Road, 9th Mile, Enugu. We hear say Oga Boys as dem dey call Ikorodu United pipu, dey travel for inside Chisco bus but God save all of dem, except for some litu injury wey dem carry for shoulder. We pray make Baba God dey with family if pipu wey kpain.
No comments:
Post a Comment