Big Bros, wey get Nairabet, Akin Alabi don talk him mind O, say he for like buy Shooting Star Sports Club, wey we dey call 3SC wey dey for Ibadan. Akin Alabi wey be beta fan of 3SC and na him company still dey Sponsor 3SC for dis season yarn him mind in tip Twitter, say he for like do pass Sponsor, and he for like buy if Governor Ajimobi go gree, but shey dis one wey dem even dey reason to sell school na him dem no go sell club. Club wey be say dem first dey owe dem gbese of how many months now, on a good day me no see reason why governor Ajimobi no go wan sell am O. And e sure me die say 3SC fans go happy of Akin Alabi buy am. If God do am say he got buy am, he go join pipu like Ifeanyi Uba wey get football club for Naija. (see him tweet afta the cut)
No comments:
Post a Comment