Ekiti State Governor, Ayodele Fayose bin talk wen den interview am, say make Bode George wey be the founder of the party (PDP) go sit down o, say him na asset no be barrier o...
Now Bode George don com out com tok say Fayose na Governor wey no mature and Fayose dey ungrateful, Fayose dey against Southwest (PDP) agenda. Bode talk say person wey PDP need for chairman na someone wey get integrity, wey dey establish. George talk say Fayose talk like person wey no mature at all wen den dey interview am, say wen pipu dry against Fayose wen he dey do hin first term for office, na him dey hin back, say he give him 250k for campaign clothes. He con talk say dem must defend Yoruba interest, say Fayose and senator Buruji Kashamu no fit decide for Yoruba pipu wey dey PDP. He con finally talk say make Fayose go read Micah 7:1-10 say the verse go teach him more about leadership.

Tuesday, May 3, 2016
SEE HOW BODE GEORGE TAKE ANSWER FAYOSE ON TOP WETIN HE TOK FOR ONE INTERVIEW...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment