One of the comedians wey dey make brain for Naija wey dey stay for Ibadan, Owomoyela Oluwatobi, wey everybody sabi as Peteru just carry joy climb on top his social media platforms today go take sweet sweet love baff him beautiful wife, wey her name na Wuraola Owomoyela. Peteru call am plenty lovey dovey names like; my Treasure, my Joy, my investment, my World, my All.... He come thank am for everything cos since she show for him life, things don dey bonsue for am cos she believe am even when nobody believe say nothing good fit come out of the life of one local Ibadan Comedian. He say even when he no believe in himself, him babe dey always believe am. Plus like dat like dat. He come take beta prayer finish the post for him babe, before he tag all him bosses and padi dem for the comedy industry. We for TPN too say Happy Byday to Mrs. Peteru.
No comments:
Post a Comment