OMOBOLA - Edo state deputy governor Dr Pius Odubu don talk o, he yarn say he no fear pipu wey won attack him on Saturday, say he go continue with hin campaign. Mr Samson osagie yarn with the journalists yesterday say dem thank God say bullet no meet their deputy governor on Saturday wen den dey campaign. He con continue say as for dem wey dey Odubu campaign organization dem go support and stand with the deputy governor make he no stop the governorship race, say as for dose who won put blood for ground on Saturday, say God go bring justice on top them.

No comments:
Post a Comment