Monday, May 2, 2016

BYDAY GIRL CHIDINMA NA WOMAN WEY DEM CRUSH PASS FOR NAIJA O

I don taya for all dis agbaya celebs wey dey follow me drag woman. Everybody for my ode Sabi say na me first dey crush Chidinma O, but. As I never fit see am tell am,  everybody don dey wan cheat me. As per say today May 2nd na her byday, everybody just dey wish her happy byday. Elenu Comedian come still go confess winsh say na Chidinma be him one and only crush for life and me sef dey crush am O. Pipu wey don crush am before na Skuki, Rugged MAN, plus many others wey I no even wan remember cos dem dey vex me. Chidinma na my own,  nobody I repeat no body should reason am say dem wan crush am commot from my hand O.  So I say Happy Byday Baby, can't wait for that time when we go be together for real life..... Lol

No comments: