Friday, May 20, 2016

ENUGU STATE DON TAKE HELICOPTER DEY SHARE DEM SECURITY

Police force wey dey Enugu don begin aerial surveillance with helicopters say sake of say dis one go make am dey easy for dem to catch any body wey wan do any how for the state. Enugu State Police for one gist wey dem give news men today  yan say because of the plan to make sure say Enugu state make sense wella dem don start aerial surveillance for the three senatorial zone for inside the state for Ukpabi Nimbo and Nsukka zone .This exercise go giv them proper sight so dem go fit see every nooks plus cranyfor inside the  state so dem go fit prevent plus control crime. Enugu CP Emmanuel Ojukwu, con dey yan say the Inspector General of police plus the Government wan ensure say the entire area is dey safe. E still con dey  advise members of the public say make dem no fear or panic as the helicopter patrol their areas.

No comments: