Tuesday, May 31, 2016

50 YEARS AFTA DEM POLONGO BIAFRA... MANY PIPU STILL KPAIN FOR THE MATA

Na like 30 pipu plus one soldier dem kpain on Monday for Onitsha, wey be capital for Anambra State, when some pipu wey dey fight, dey do Aluta for  Biafra, say dem dey celebrate 50 years wey dem polongo Biafra republic, follow soldiers plus policemen enter the same trouser, come burst kasala. But sha O, Pipu wey lead the aluta no gree show dem dead body of pipu wey dem say dem kpain, but see punch person say hin see 2 dead body for Onitsha on Monday. The Biafran Oga wey don die, Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu, polongo say dem dey commot Republic of Biafra from Nigeria on May 30, 1966. But the anniversary wey dem wan do turn gbege when members of the Indigenous People of Biafra (IPOB) go burst kasala with security pipu for Onitsha and some members of  Movement for the Actualisation of the Sovereign State of Biafra (MASSOB) too go follow security pipu drag for Asaba, wey be Delta State capital, na for there tori yarn us say dem kpain 2 policemen. For anoda tori we hear say Joint Security Taskforce go catch Nnewi South Regional Administrator of MASSOB, Anthony Nwodo.

No comments: