Tuesday, April 26, 2016

WOW... POPULAR CELEB PHOTOGRAPHER, OLERE DON DASH GOD HIM PIKIN

shebi for time wey no too tey na him we yarn una say popular celeb photographer wey take Ibadan do him kabba, Oladipupo Akinpelu Akinfenwa wey every body Sabi as Olere born pikin. And as per Yoruba package he don sama the pikin beta name, so dis last Sunday wey be 24th of April na him he do him baby dedication wey he carry the pikin go church go dash Baba God. Make he dey take care of the baby, dey do beta for am. See as Olere do face like say the thing dey pain am.... Lol. Bros no worry, I believe you know God go take care of the baby pass you sef. We for TPN say congratulobia to the photo winsh.

No comments: