MISS SIMPLICITY - Billy Paul na one American singer wey pipu dey gbadun him songs dat time base on sey d guy knw wetin him dey do naim we hear sey he don die on Sunday, April 24, 2016, d same day wey king of Rhumba Rock, Papa Wemba wey be Congolese singer die o. Billy Paul die for him house wey dey New Jersey afta him lose d battle wey him bin dey fight wit Pancreatic cancer..
.no be small tin o. The man na 80yrs before him kpai o nd he get one wife nd two children oooo... Hmmmm one musical icon wey be R&B pioneer don go o nd we for TPN dey pray sey o make Baba God give d family d strength wey dem need to take bear wetin dem dey pass through so oooooooo.
No comments:
Post a Comment