We Vice Presido Yemi Osinbajo on Monday don Loud am why light no dey for plenty parts of the country last weekend na bcos say 99.6 per cent of we total electricity generation na him throway for one day. Osinbajo say 3,132 megawatts of we total electricity wey dem generate on Saturday, April 23, 2016 na him throway. That one na against the 3,144MW wey dem generate on Friday, according to data wey dem collect from the Federal Ministry of Power, Works and Housing. Na him be say we don lose 99.62 per cent of the energy wey dem generate for one day. Oga say wetin cause am na gas palava, pipu wey dey burst pipeline and things wey no dey to take carry the gas wey dey cause all dis kasala wey we dey face for we power mata.
No comments:
Post a Comment