Friday, April 29, 2016

TOOR.... PHILIPPINES PRESIDO SAY ISLAMIC MILITANTS DEY PLAN TO KIDNAP MANNY PACQUIAO

On Wednesday, dem presido for Philippines, President Benigno Aquino III yarn say him and boxer Manny Pacquiao dey in top list of pipu wey one yeye Muslim extremist group, Abu Sayyaf, wan kpain. Na the same group cut the head of one Canada pikin early dis week. The presido say the group dey plan to fall am and dem don ready plan to kidnap Pacquiao or one of him pikins. Manny, say he shock to hear wetin dem Presido yarn o cos he no get Dat kain idea at all  expressed shock today at until when dem presido talk am  but now he don dey take beta security measures to make sure say him family safe. He come even say dem presido no try at all,  COS HE suppose don yarn am before he go talk am for public.

No comments: