Friday, April 29, 2016

GOD CATCH 3 PIPU WEY WIN CHOP RETIREMENT MONEY OF ONE MAN WEY DON KPAIN

EFCC don show face of some pipu  yesterday April 28th, the 3 of dem na Patience Owerema, Nwakaudu N.Francisca plus Okafor Kingsley. So dem show dem face for front of Justice Binta Nyako of the Federal High Court wey dey siddon for Abuja say dem dob4 bad things wey be conspiracy, abuse of office, forgery, impersonation plus say dem kolobi money wey dey go like N3, 766, 160.00 (three million, seven hundred and sixty-six thousand, one hundred and sixty naira). Tori yarn us say dem gather hand kolobi N3, 766, 160.00, wey be money wey dem suppose pay one  Udemba Clement, wey don kpain and still be former employee for NITEL/MTEL and Papa of the person wey write the letter go give government, Udemba Emmanuel. Since him Papa kpain. Na him the guy don dey hustle to collect him Papa money but na scope dem just dey scope am. The guy come go hear gist say this bad pipu don go open account for the money and dem don pay him Papa money enter the account.

No comments: