Friday, April 29, 2016

SEE WETIN GLAMOUR UK MAGAZINE DO GIVE KYLIE JENNER

MISS SIMPLICITY - Glamour UK magazine don sama us wit their magazine nd na Kylie Jenner naim dey for d cover o. For d cover she do small makeup wey make her come really be like her real age o nd for d magazine she tok abt hw neva take moni for her mama hand since d time wey she dey 13yrs o, how she don take dey make her own moni nd dey pay her own bill o. She tok sey she be young woman wey no dey like depend on anybody o, she sey na only she dey take care of herself o from d business wey she dey do, nd she no dey spend moni yanfu-yanfu that is to sey she dey watch d way she dey spend... Hmmm like she tok ham, she sey she be inspiration to oda young pipu, me sef think so o

No comments: