Friday, April 8, 2016

PLENTY ALHAJI.... K1 DE ULTIMATE DEY ROLL FOR UMRAH WITH OBA ELEGUSHI

Kaboni tuti for Fuji Music,  K1 De Ultimate wey be Alhaji from tey tey don go mecca go add anoda feather join him Alhaji cap as he dey less hajj now for Mecca Medina. Na on Wednesday Alhaji first pit the pinshure for him facebook page as dem dey land for Medina. One thing wey make person Sabi say Alhaji no be anyhow person na the kain pipu wey he dey follow roll,  even for holy land. Na him and Oba Elegushi Waka together and from pinshures wey he sama for Facebook again we fit see an set roll with some mega man for the Holy Land. Abeg help me send message give dem make dem help us beg God for for O and wetin again sef?

No comments: