Friday, April 8, 2016

ORISHIRISHI... DOCTORS SAVE GAY WEY CASSAVA HOOK FOR HIM YAN*H AS HE DEY TOTORI HIM SELF

Dis one be like craze tori, na surgery dem take save one guy afta dem commot 18 inches cassava, wey he do like John Thomas (Penis) go hook for him yan*h as he dey take am totori himself for himself by himself. The. Man wey dem no gree mention him name go find thinks take shape the cassava make he be like penis. Dem say he try use brain cos he don wear 2 condoms for the cassava,  but he sharperly halla doctors when one of the cassava go break for inside. He bin don try commot am,  but as he see say na die he dey,  na so the 55 year old sharperly find help. Doctors for San Juan de Dios Hospital for Costa Rica take like  2 hours before dem fit commot the thing but dem thank God say the guy no kpain. Abeg wetin he for talk for heaven if to say he die ni?

No comments: