Friday, April 8, 2016

PEKELE PEKELE... WETIN FIT MAKE DIS KADUNA PASTOR DEY BEG NAIJA PIPU

Barnabas Yohanna wey be Presido for Bridge of Life Missions Inc wey dey Kaduna state climb in top him facebook wall go dey beg Naija pipu make dem forgive am sake of say he campaign for APC during last election. That one dey follow as some pipu don dey quick regret why dem vote for change cos the change wey dem dey expect,  no be him Sai Baba and him goons dey sama dem. Lol

No comments: