Friday, April 8, 2016

POLICE MAN FLOG LAWYER FOR LAGOS... ON TOP WETIN?

42 year old Sunday Elimihe na  lawyer for Lagos and he don dey accuse police officers wey dey Onipanu Division for Lagos state say dem flog am, woundjure am for eye. Tori yarn us say dem rush  Elimihe go Shomolu General Hospital on Thursday, afta the policemen flog am as he no gree give dem N1,000 bribe. When he dey explain as the thing go for hospital where he say na from Lekki where he go check one property with him client he for dey come, he come day Make he pass  Onipanu police station road, wey dey Apata side. He say as he enter the street,  dey near the station, na so one Corporal Alonge stop am  say where him particulars,  and he give am, he ask for license he give am. He say when he see say he no do any bad thing, he still ask for him tinted glass permit wey he still give am, na so he say the permit na fake. I yarn am say I no fit do fake na,  base in say I be Lawyer, na so he vex, say he go catch me. He jump enter my car and say I gats to roger am 1k to take bail myself. Na so I clear am say kobo I no dey give am. He one commot him gun say if I move again na shoot he go shoot me. He say na anoda policewoman wey see dem come collect gun from him hand,  as dem come collect gun from him hand, na so he bombard am with beating of life come push am enter cell.

No comments: