I no wan Sabi how much you like the guy, but I Sabi day me too I like am well well and I dey always yarn am say the guy still dey 100% cos he don release 3 songs and all the 3 make sense die. Dat na why I brush download am wen I see say he don drop another song. Wetin first make me feel one kain, na when I hear say na him own version of flavor song Ada-Ada. But as per say O trust am, I still download am, the song just be one kain for hear, the production get as e be, the lyrics no gel well with the tune and like Dat like Dat.... Na so he take fall my hand cos I no fit imagine say I wan hear the song again, if no be say na money I take download am no, I for don delete am. Bros, this one no try O, sharperly drop a beta one take cover dis mess. I still be your guy sha. As per say 3/4 na still beta mark.
No comments:
Post a Comment