The Court of Appeal wey dey siddon for Abuja din yarn on Monday say dem no dey hear cry say make dem stop mata wey dey court against we Senate Presido, Bukola Saraki; former National Security Adviser, Col. Sambo Dasuki (retd.); plus the National Publicity Secretary of the PDP, Chief Olisa Metuh. Justice Abdul Aboki, wey siddon on top the mata say with 2 other judges para wen dem call Metuh mata on Monday, say make dem no try yarn am that kain thing again. When Metuh Lawyer wan reply, Mr. Onyechi Ikpeazu (SAN), say he think say dem go fit allow am talk him mind ni, maybe court go fit think the mata again. Justice Aboki say lailai, dem no go gree for am cos even if dem bring the mata, na throw dem go throw am away.
No comments:
Post a Comment