MISS SIMPLICITY - Ernest Azuzu na one guy wey bin dey shake d movie industry wit him swag bt for sum time now he no dey show face for film and pipu com dey tok sey e don die bt d actor don come out com tok sey him no die, him just get stroke ni o. He tok sey dem bin admit ham for LASUTH o and he para sey d pipu for Nollywood no dey try at all on top sey wen him dey hospital o, dem no visit ham o. Ernest tok sey d stroke o don make ham no dey waka well o bt him neva die. He com tell pipu sey abeg o make dem dey confirm sumtin well well before dem dey tok ham ooo.. Hmmm we thank Baba God for ur life o oga Ernest nd we pray sey make He sama u wit beta health ooo.
No comments:
Post a Comment