Islamic Movement for Nigeria, wey dem still dey call Shittes group don polongo say no be dem kidnap Naija Colonel for Kaduna last Saturday o. THISDAY Newspaper yesterday talk say one officer say e fit be say pipu wey do am na Shiite members wey dey vex for Naija Army on top the December 2015 gbege wey make dem catch dem Oga Ibrahim El Zazakky plus kpain over 50 of dem members. The officer say e be like say na wetin dem wan do say dem go come talk later say dem wan exchange later. The group don talk sha say na lie O, dem hand no dey for the kidnap mata O. For one statement wey dem sign by the Presido for Media Forum of the Islamic Movement for Nigeria, Ibrahim Musa, dem say na lie and bad Belle make dem dey yarn dat kain thing O, cos dem just wan spoil dem name ni.
No comments:
Post a Comment