Friday, April 15, 2016

OMOTOLA JALADE EKEINDE DON ANSWER FAN WEY TELL HER SHE TOO DEY OPEN BODY

MISS SIMPLICITY - Earlier dis week Glitz Africa Magazine celebrate Omotola nd na her picture dey for their cover, d actress make sense for d photos bt e be like sey one of her fans no like ham as she come tok sey omosexy too open body o, she tok sey time don reach make omotola stop to dey bear omosexy sake of sey she don old nd she go soon get grand pikin O. Like we know sey Omotola wey be screen goddest no dey like reply or yab any fans wey tok anyhow, instead she dey always take her time dey explain, na so she do for d fans wey dey criticize her o. Omotola thank d fans na so she com tok sey she be entertainer o nd na d Omosexy brand naim she dey represent o nd as for d age wey d fans tok, she knw sey she don dey old o bt she know wetin gud for her ooo... Chai see answer, dis na one of d best answer wey she don ever give her fans...very interesting. Ma'am Omotola Jalade Ekeinde, u too much, Iyi e po ni gboro (Pipu knw ur worth for town jare......

No comments: