Monday, April 18, 2016

NAIJA ARMY DON BURY DEM GUY WEY DEM KPAIN FOR RIVERS ELECTION






No be small cry on Friday as dem dey bury Lance Corporal Adegboyega Adebayo, one of the 2 soldiers wey badt guys kpain 2 days before the election re-do wey happen for Rivers State, dem bury an for Iyesi area for Ogun State. For the burial, na so so cry him parents, brothers plus friends of the 34-year-old soldier, wey dem shoot die on top sea for Abonema, Akuku-Toru Local Government Area of Rivers



 State on March 17. Tori yarn us say both the Rivers State and the federal government no even show say the mata concern dem cos apart from the military, no government official even send message abi show face even say na for work he kpain. He still get parents, wife plus 2 children – Marvelous, 6, and two-month-old Mercy – Tori yarn us say Adegboyega na the breadwinner for him full family. Dem say na work he even dey when he wife born dem last born.


No comments: