Dem don carry plenty security pipu go Ngo community for Andoni Local Council for Rivers State make dem go catch pipu wey hayaj police station yesterday. Tori yarn us say for Ngo town, wey be headquarters for Andoni council, say members of MEND go hayaj one police station early momo yesterday and dem carry some weapons. One Chief wey say make dem no mention him name say na since January 2016 those badt guys don dey do dem strong thing for the area and na around dat kain 4:00am dem hayaj the police station dey shoot any how. He say the police try sha, but dem no fit stand those guys cos dem force dem way enter where dem dey keep gun and carry dem run. The Andoni caretaker committee chairman, Victor Ere, who later confirm the hayaj say na 2 AK47 assault rifles plus one other weapon na him dem carry run.
He say dem don carry naval gunboat go Ngo, plus 150 anti-riot policemen wey one assistant commissioner of police lead say make dem go catch the badt guys.
Wednesday, April 6, 2016
NO BE SMALL MATA O... SEE WETIN ROBBERS DO POLICE STATIONS FOR RIVERS STATE
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment